Songtext zu 'Authority Stealing' von Fela Kuti

Authority Stealing ist ein Lied von Fela Kuti, dessen Text unzählige Suchanfragen hat, deshalb haben wir entschieden, dass es seinen Platz auf dieser Webseite verdient, zusammen mit vielen anderen Liedtexten, die Internetnutzer kennenlernen möchten.

[Chorus]
Authority stealing!

You be thief (I no be thief)
You be rogue (I no be rogue)
You dey steal (I no dey steal)
You be robber (I no be robber)
You be armed robber (No be armed robber)

I no be thief (You be thief)
I no be rogue (You be rogue)
I no dey steal (You dey steal)
I no be robber (You be robber)
I no be armed robber (You be armed robber)

[Chorus]
Argument, argument!

Argument, argument, argue
Them argue
Everbody dem argue
Them dem dem argue
Up and down them argue
Everbody dem argue
Them dem dem dem argue
Yes yes, them argue
Everbody dem argue

Argument about stealing
Somebody don take something
Wey belong to another person

Then you go hear:
You be thief (I no be thief)...

On top of the road, on the side
People dey waka
Office workers, labourer workers, workers' workers
Them go dey waka
Inside bus them go dey
Motorcycle them dey ride
Plenty, plenty crowd
Inside this crowd
Sometimes for one corner
Sometimes for one street
You go dey hear: ha ha!

[Chorus]
Thief, thief, thief!
Rogue, rogue, rogue!
Robber, robber!

Catch am, catch am! Thief, thief, thief!
Catch am, catch am! Rogue, rogue, rogue!
Catch am, catch am! Robber, robber!
Catch am
Pull am
Get am
Keep am
Ole...

[Chorus]
Catch am, catch am!

Looking go start
Watching go start
Chasing go start
Somebody go dey
Wey them go grab

Them go beat am well-well
Them go lynch am well-well
Police go come well-well
Them go carry am go court
Them go put am for jail

Them fit put am six months
(Them go put am for one year)
Them fit put am two years
(Them go put am for five years)
Them fit put am seven years
(Them go put am for ten years)

If not them go shoot am well
Them go shoot am for armed robbery
On top of the road, on the side
People dey waka
Office workers, labourer workers, workers' workers

Them go dey try
To try to make ends meet
Them go dey hustle
To try to make ends meet
Them go put hands for back
To try to make ends meet
Them go dey beg oga
To try to make ends meet
Them go be slaves for them town
To try to make ends meet

I say turn your face small
To the right wing
Oga patapata dey for there
Authority people dey for there
Instead of workers
We have officials
Instead of buses
Them dey ride motor-car
Instead of motorcycle
Na helicopter
Instead of them waka
Na worker go waka for them

Authority people them go dey steal
Public contribute plenty money
Na authority people dey steal
Authority man no dey pickpocket
Na petty cash him go dey pick
Armed robber him need gun
Authority man him need pen
Authority man in charge of money
Him no need gun, him need pen
Pen got power gun no get
If gun steal eighty thousand naira
Pen go steal two billion naira

[Chorus]
Thief, thief thief!
Rogue, rogue, rogue!
Robber, robber!

You no go hear them shout
You no go hear them shout at all
You no go hear them say
You no go hear them say response at all

Na different way be them way
Na civilize style be them style

[Chorus]
Yes, yes, yes, yes!

"Oh yes, of course, contract, have some money back in hand, ha ha"
Hear the words them dey take deceive the people:

Misappropriation
Maladministration
Nepotism
Mitigation
Make I remember another one wey them dey use
Defraudment
Forgerylization
Embezzlement
Vilification
Mismanagement
Public inquiry

Authority stealing pass armed robbery
We Africans we must do something about this nonsense
We say we must do something about this nonsense
I repeat, we Africans we must do something about this nonsense
Because now authority stealing pass armed robbery

Authority man him go dey steal
Public contribute plenty money...

[Chorus]
Authority stealing!

Der häufigste Grund, den Text von Authority Stealing kennenlernen zu wollen, ist, dass du es wirklich magst. Offensichtlich, oder?

Wenn deine Motivation, nach dem Text des Liedes Authority Stealing zu suchen, war, dass du es absolut liebst, hoffen wir, dass du es genießen kannst, es zu singen.

Etwas, das öfter passiert, als wir denken, ist, dass Leute den Text von Authority Stealing suchen, weil es ein Wort im Lied gibt, das sie nicht ganz verstehen und sicherstellen möchten, was es sagt.

Streitest du mit deinem Partner, weil ihr verschiedene Dinge versteht, wenn ihr Authority Stealing hört? Den Text des Liedes Authority Stealing von Fela Kuti zur Hand zu haben, kann viele Streitigkeiten beilegen, und wir hoffen, dass es so sein wird.

Wir hoffen, dass wir dir mit dem Text des Liedes Authority Stealing von Fela Kuti geholfen haben.

Denke daran, dass du dich immer an uns wenden kannst, wenn du den Text eines Liedes wissen möchtest, wie es jetzt mit dem Text des Liedes Authority Stealing von Fela Kuti der Fall war.